Skip to main content

Onitsha market fire: Fuel tanker explosion don cause palava






  •  
   



Image copyright@FOLLOWLASTMAFire dey burn
Image captionLagos-Otedola tanker fire accident wey hapun for 2019

Katakata burst for Onitsha, Anambra south east Nigeria afta tanker wey cari fuel fall, catch serious fire wey later spread long distance.
Di fire wey area pipo say burn well-well start since twelve for afternoon reach evening.
One pesin wey dey stay di area tell BBC say di fire affect Ochanja and Relief markets.
Although police say di fire don reduce compare to wen e first start, dem neva sabi weda pipo die inside di fire..


Inside videos and foto wey pipo share for social media, some pipo bin dey run helter skelter for dia life and property while odas dey hustle to try get water quench di fire.



Kpele, dis Twitter post no dey now.


Meanwhile, di Anambra state govnor Willie Obiano, don set up panel to chook eye for di mata.
Di govnor don also invite all di pipo wey di fire affect to gada on Monday October 21 to see how goment go fit to helep dem.

Comments

๐Ÿ‘‰Latest ๐Ÿ‘ˆ

CONGRATULATIONS AS 20 OMOALADE ALAFIA , BARIGA CELEBRITY HAIR STYLIST SHONUBI IDOWU TAIWO Boss Celebrates her Birthday In style

NYSC: 11 COMMONLY ASKED QUESTIONS YOU NEED TO KNOW TODAY